Ads
HomeNewsTinubu Gets Open Letter By Charly Boy Over Trump Wahala

Tinubu Gets Open Letter By Charly Boy Over Trump Wahala

Ads

Dear Jagaban (Mr President)

I don yab you, I don tire. If i ever insult you, pls forgive me, am only a frustrated Nigerian who belive we can do way better than we are doing presently, because the Youths of dis country deserve a New Nigeria of their dreams.

Ads

For decades now, we don dey shout, we don protest tire, we don cry, we don beg tire even as many people dey face where dem belle dey face. Our voices don disappear inside government office like smoke. Our children dey die for their mama hand, our men dey miss for road wey no get end. The rate wey men dey take die these days, dey fear me. We don beg for security, for small peace, for life wey make sense but somehow, na una own easy life go always get priority pass our pain.

Now, one small tweet from American President  don troway Nigeria put for round-about.

The world now don dey torchlight Nigeria.

So na until were Trump use him microphone talk our pain before e get value?

Mr President, I dey ask you, you go finally act now or you go still wait till another tragedy trend before una remember say Nigerians dey alive?

Make we talk am straight, this no be Christian or Muslim matter.

It’s about the greedy rich Nigerians and the poverty stricken Nigerians.

Nigeria dey bleed from every corner.

When I talk North, I no dey talk one religion, I dey talk people, human beings wey dey suffer.

North dey cry, South dey hungry, East and West no better pass. Everywhere dey choke.

Some people never chop for days. Families dey run from home just to stay alive.

Na so we go dey continue to pretend say everything dey alright?

E pain my heart, e pain the soul, and as Area Fada, I no wan carry evil thought inside my mind. Something must be done.

Leadership suppose protect life, no be only issue statement.

Mr President, the thing don pass shame e don turn tragedy. Water don pass Garri. Nigeria don sawa.

Life suppose get value again for this country.

We don watch, we don pray, but this time we dey demand.

No more empty promise. No more waiting for another trending disaster.

Nigerias also need to wake up.

Mr President, the time to act no be tomorrow, no be next week, na now.

No be you be Jagaban?

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Ads

Must Read

Ads