Home Views and Reviews One Prayer Obasanjo Provoked In Charly Boy After A Hectic Day Together...

One Prayer Obasanjo Provoked In Charly Boy After A Hectic Day Together In Abeokuta

0
19
Ads

One Prayer Obasanjo Provoked In Charly Boy After A Hectic Day Together In Abeokuta

Obj. The grand wizard.

Make I gist una something

The 27th day of April,
My body Feelam.

I wake up 5am, prepare like a man wey get mission.
6am, I don comot house my house on my way go Abeokuta.

I Reach Abeokuta around 8am, traffic still show me small shege.

I go to meet, Baba Olusegun Obasanjo The biggest spiritual wizard alive because na him office dey handle invitation matter for my New Book, 999 The Memoir of CharlyBoy.
I carry full guest-list go give Obj make him see everybody wey suppose showup on the Lunch Date and to do a 1mint video shout out to Nigerians, announcing 999.

As l land Baba house, people full like say na market sq. People, everywhere, crowd na water.
All to see the Wizard. Donald Duke cuma dey dia.
But Baba still carve time, call me, collect the list, check am well, and handed everything to his secretary of 50 years. Mr Taiwo.

Next thing, Baba practically dragged me into his car. “I want you to ride with me to a town called Ilaro, which is another 1.30mints away from Abeokuta”
like mumu I follow am. Cos the vibes and the silent lessons I dey learn from dis my Daddy is not of dis world, hece I call him a wizard.

Journey start.

Almost two hours for road wey no even good. Na so driver dey douge potholes like him dey dough bullets.
As we reach the construction site wey Baba go carry me to inspect, when we comot from inside Baba ac car, the kin satanic sun wey descend on us, nobody tell me to run go inside car go take cover after 5mints
In all the Dust. Heat. Wahala. Baba was in dat sun for at least 40mints.

When we finally got back to Abeokuta, I told Baba to change into something more traditional,  Baba after looking me up and down called former Cross River Gov, Donald Duke, reporting me to him. “Donald see dis jaja person wey say make I go dress up fine say e no like wetin I wear”
We all busted out laffing.
Dis man na comedian aswear.

I had to prepare my dady to look Royal for the video endorsment of 999.

As stage set and I don brief Daddy as e go keep mouth, na so Baba become the encyclopedia of CharlyBoy, Baba spoke on the brand for almost 1hr, sometin wey suppose take 5mints, at most.

By the time I reach Lagos, past 6pm and when I no even drive, my body don already give up.

Next day, na so one of Baba’s aide wake me up to make sure say I reach Lagos safely. Most of Baba’s Aide’s are all my fan.
Him come dey gist me say, immediately after i left, Baba still get mind to go play squash, still come individualy talk to almost 60persons wey come see am.
The thing wey dey high me where dis man dey, na him energy When some of him mates dey for wheelchair, some no fit waka without walking stick, some are riddled with all kinds of ailment. Even as I dey follow Baba walker, some times, na catching up with him na assignment.

My point,

Dis kin Energy no normal.
I know say no be Juju, it’s a healthy life Style plus blessings from above.

So make una stop to dey wash my head by telling me I look good for my 70sometin yrs on earth.

If a 89 years old still get dis kin of ginger, energy,  Still dey move like dis, na him be say I never start, Still dey show up like this.

I come dey ask myself

Wetin be my own excuse?

Because this one no be ordinary energy.
This na something deeper.

I just remove cap for Baba.
Respect.

Because if life carry me reach that age I pray make I still get this kind Fire 🔥

CHARLY BOY/X TWITTER/28 APRIL 2026

NO COMMENTS

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here